TENANTS, LANDLORD AND COROLLA VIRUS.
This lock down nor be small thing e don cause Boys dey hungry boys not get work Ejiro na girl for the compound she carry stove dey cook stew Boys wey they lament inside houz begin jolificate say time don due "Wetin we go do like this" Efetobore ask Tega "Shey we get rice make we boil rice, this one go mega" Na so boys take boil rice for another man stew This na the story of the things wey dey happen for the street One hour later Efe and Tega carry plate go Ejiro gate "Who dey houz o" Efe talk. "Hope say we nor late" Ejiro open her door, she tie wrapper, she get big bust "Wetin be this" Ejiro ask dey look the plate wey them hold Tega con talk say "Give us small stew na small we want nor want overload" Ejiro change am for them "Shey una dey mad? which kind level be this na" The boys sidon for ground say she must kill them now now Landlord con come outside Wetin be all this commotion about The boy...