TENANTS, LANDLORD AND COROLLA VIRUS.
This lock down nor be small thing e don cause
Boys dey hungry boys not get work
Ejiro na girl for the compound she carry stove dey cook stew
Boys wey they lament inside houz begin jolificate say time don due
"Wetin we go do like this" Efetobore ask Tega
"Shey we get rice make we boil rice, this one go mega"
Na so boys take boil rice for another man stew
This na the story of the things wey dey happen for the street
One hour later Efe and Tega carry plate go Ejiro gate
"Who dey houz o" Efe talk. "Hope say we nor late"
Ejiro open her door, she tie wrapper, she get big bust
"Wetin be this" Ejiro ask dey look the plate wey them hold
Tega con talk say "Give us small stew na small we want nor want overload"
Ejiro change am for them "Shey una dey mad? which kind level be this na"
The boys sidon for ground say she must kill them now now
Landlord con come outside
Wetin be all this commotion about
The boys con reason am the matter
The landlord con say why you go they reason person food like that
The boys con let am know say nor be their fault say na lock down be the cause
Say na corolla virus be the craze. Landlord shey you dey relate?
Na so landlord carry e hand from he back
Him sef they hold plate nor be small
"Ejiro gimme stew sef, my rice go soon burn"
Na so all the tenants shout "Landlord you sef??!"
This is the only thing I am going to write about the Pandemic. I hope the when all of this is over, I can look over at this poem and laugh my balls out e even though I don't have balls and until then, continue to stay safe. 😊

Comments
Post a Comment